TIGblogs TIG | TIGblogs GROUP TIGBLOGS LOGIN SIGNUP
ADEBARI ADEOLU's blog
Psalm 23 in the Naija Style

1. The Lord na my shephard, i dey kampe.
2. E make me sidon for where betta dey flow and come put me next to stream make mai bodi thermacool.
3. E panel beat mai soul come spray am white, come dey lead me dey go through express road of righteousness sake of Hin name.
4. Walahi !, if I waka pass where arm robber, 419 and juju people boku, come even join okada reach valley of the shadow of death sef, mai bodi dey inside cloth. Your rod and staff nko ? Na so dem dey like back bone dey comfort me.
5. You don prepare Egusi and Pounded yam make I chop. All mai enemies dey look waa waa. You rub me for head wit vaseline intensive lotion. mai cup na River Niger wey overflow hin bank.
6. True true, betta life and mercy go gum mai back till I quench. And man pikin go tanda for God house from lai lai to lai lai.

GOD ALMIGTHY NA YOU BIKO
AMEN.

May 27, 2006 | 2:06 AM Comments  0 comments

Tags:
You must be logged in to add tags.


ADEBARI ADEOLU's Profile

ADEBARI ADEOLU's Friends


Latest Posts
National Association...
FRAUDULENT LECTURERS...
LIKE SADDAM, LIKE...
Wise Counsel
Psalm 23 in the Naija...

Monthly Archive
September 2005
October 2005
January 2006
May 2006
June 2006

Change Language


Filter By Type
News
Travel

Friends
Erika
Greet Narsingh


11105 views
Important Disclaimer